Nigeria Indepenednt National Electoral Commission (Inec) don come unda ogbonge pressure and criticism sake of dia alleged failure to publish di voters register in accordance wit di Electoral Act 2026 as amended. Opposition figures and civil society don chook mouth for di mata as dem claim say Inec dey break di law wey suppose guide di electoral process for Nigeria.